*All times CAT (GMT+2)

Football | Naija

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Jose Mourinho © Action Images

We no fit catch Barca-Mourinho



Jose Mourinho no bilif say Madrid fit catch Barcelona again, to come retain dem tiltle afta dem bin draw 2-2 wit Espanyol for house for Sunday match.

Barca wey dey unbitin, hammer Atletico Madrid wey be secon for table 4-1, Messi score two inside d goal for d match for Nou Camp come carry 13 point gap Real wey dey numba 3 for table.

" Lai lai, e no fit happen," Mourinho tell one news confirence " D gap plenti no be small for dis stage wey we dey, last year we gif Barca 10 point for februari time come hold am like dat take win d Lig.

" But as e be so if we go fit omprof for Lig, e go helep us for King's Cup and Champion Lig sef.

Real dey struggle to show d kain form wey dey show lass year wey dem scatta rekod yakata, and dem drop 15 point sef wit d 3 draw n d 3 difit wey dem get wey pass all of last seasin own.

Barca sef don win all dem Lig game dis year minus d one wey dem draw 2-2 wit Real for October time.

As Madrid bin lose 2-1 for Celta Vigo hand for King Cup , pipul come dey talk say Mourinho sef fit waka befor im kontrak go finish for 2016 time.

" E don tey wey i dey dis kain position, i no juss undastand, d kain points wey we dey drop no good at all, we suppose go bak, think am well well, come do beta tin for field, we no fit dey continu like dis" Mourinho talk.

Barca sef no send d win wey dem win dem rival Atletico becos dem bilif say as seasin dey go, Atletico and Madrid go dey gif dem close marking dey shadow dem.

Midufilda Sergio Busquets talk say say " Na good advantage but Lig still dey far, match plenti, nobodi bin tink say we go dey where we dey, but we go dey continu to dey do wetin we dey do."

Atletico coach Diego Simeone no gree wit wetin Busquets talk sef " Barca no be we mate, na different level dem dey, dem ball pass be careful, " Simeone bin yarn ,after Barca cari 9 point gap dem for numba 2 position.

" We bin try to play too, we play d way wey good for us, we try sef for d game, but wit d kain ogbonge attak wey dem get, e no fit happen, dem too much.

" Messi na d best player for dis world. Me just hapi say me and im come from Argentina.

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



John Dykes
Wunderbar Wembley date
I’m honoured to be part of SuperSport’s presentation team for this weekend’s Uefa Champions League...

Neil Tovey
Why Baxter’s way has worked
When Kaizer Chiefs first announced the appointment of Stuart Baxter, the decision was met with a...

Dr Errol Sweeney
Why are referees explaining their decisions?
Match officials make mistakes because they are like you and me - human. However, in modern...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...