*All times CAT (GMT+2)

Football | Naija

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Roberto Mancini with Alex Ferguson © Action Images

New ogbonge mobile site for Naija



Contri people, na the new thing wey dey happen for SuperSport we want tell una so. Na him be our new website wey una fit look for inside una mobile phone internet.

Dis na the tori wey we get for una as e be say naija people like ball well well. Na yesterday, wey be Thursday, 14th December, 2012 na him wey we bring am out.

So, for inside una phone, una go just type www.supersport.com, and one hand, the thing go carry una inside the website for una telephone.

E no Mata which kind phone una dey use , so far, una fit look internet, na him be say, everything about all the ball wey dem dey play for Barclays Premier League,

Uefa Champions league sef and the Nigeria Premier League. Even sef, this one wey dem wan play Africa Nation Cup for South Africa, na we go bring una all the tori Brekete as e dey happen for our doormat.

The thing wey make us special na say you fit look video of any match wey dem don play for inside your phone one hand once you enter inside the website. No be small thing oh.

So as e be so, wether na Nigeria Premier league or na Super eagles tori you wan know or na the rofo-rofo fight wey Lionel Messi and Ronaldo dey take drag who sabi play ball pass or na the Naija Players wey dey obodo oyibo .

Even sef, all the ball wey Arsenal, Chelsea and Liverpool dem dey play or the gragra wey Manchester City dey take money do dem neigbours wey be Manchester United long throat and also follow Them drag the Premier league cup. Na here una go fit get all the results too.

Make una tell una freiends make dem follow una look and also tell us how una see am. Oya make una enjoy

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R194.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R341.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



Collins Okinyo
Ethiopia are an example
Many pundits may have known Ethiopia for its prowess in athletics rather than football. Yet they...

Sunday Oliseh
South Africa's only solution
In 1996, the world was graced with the emergence of a colourful and flair-filled footballing...

Segun Odegbami
Nigeria, Tahiti played like schoolboys
I needed to watch a few games before making any analytical comments about the Confed Cup. II needed...

Richard Owubokiri
Let the dress rehearsal begin
We are hours away from the start of what will be a perfect dress rehearsal for the Brazil 2014 Fifa...

Dr Errol Sweeney
Well done PSL - thuggery must stop
The hefty bans imposed on a soccer player and the chairman of an NFD club by the Disciplinary...

Clyde Tlou
Let Ronaldo go
This soap opera of Cristiano Ronaldo wanting to leave Real Madrid is turning into a monotonous tale...