*All times CAT (GMT+2)

Football | Naija

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience

Our win no be fluke-Rooney



Wayne Rooney belif say na d winning mentaliti and confido wey dem Coachee Alex Ferguson gif dem na im make dem take beat dem nebo Manchester City for the match wey dem play.

Efri bodi sabi d way Manchester dem dey take come from back win match even if na dem dey lose, but e come be like say stori don turn upside down wen Zabaleta equalise for 86 minute for City.

D goal sef wey d Argentina defenda score come make d game 2-2 afta Yaya Toure bin score d fess one come comot d two gol advantage wey Manchester United bin get, but Van Persie freekik for inside injuri time make sure na United come win d match.

Dat na City fess loss for dis season and e come make United carry ogbonge six point gap dem rival and nebo City for table for d 16 match dem play dis season.

"No be fluke oh" Rooney talk. "Luk as d match take happen, we no dey ever gif up lai lai, we dey carry go till referee go blow, and na Sir Alex na im teach us dis beta mindset, we no dey gif up at al at al.

D victory sweet Manchester United for belle no be small if u check am see say na d sam City hammer United 6-1 for Old Trafford last season so, come nack dem kondo 1-0 for Etihad sef as City take win d lig for d fess time inside 44 years.

Rooney sef happy dsay na dem break Manchester City record for house, say dem don dey wait for d chance make dem revenge, as dem come beat City, Efribodi dey hapi well well Na Rooney fess open door for d 16 minute as im shot take beat im colleague for National team Joe Hart for City post, before e take double d score to 2-0 from d cross wey Rafeal cross.

D second goal wey Rooney score na im 150 gol for Premeir League for Ingiland, and e come make am d younges player to reach d numba, come add on top say now, im be United leader for gol wey dem score for d Manchester dabi with 10 gol.

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R194.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R341.95


Comments

Sports Talk



Richard Owubokiri
Now is the time for Neymar
The Fifa Confederations Cup kicked off as well as expected. All the talk so far have been about one...

Collins Okinyo
Ethiopia are an example
Many pundits may have known Ethiopia for its prowess in athletics rather than football. Yet they...

Sunday Oliseh
South Africa's only solution
In 1996, the world was graced with the emergence of a colourful and flair-filled footballing...

Segun Odegbami
Nigeria, Tahiti played like schoolboys
I needed to watch a few games before making any analytical comments about the Confed Cup. II needed...

Dr Errol Sweeney
Well done PSL - thuggery must stop
The hefty bans imposed on a soccer player and the chairman of an NFD club by the Disciplinary...

Clyde Tlou
Let Ronaldo go
This soap opera of Cristiano Ronaldo wanting to leave Real Madrid is turning into a monotonous tale...