*All times CAT (GMT+2)

Football | Naija

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Lionel Messi © Action Images

Messi don scatter Muller record



Lionel Messi don step reach anoda ogbonge levels for im wondaful career for Sunday match with Betis as im come set rekod for d numba of goals wey pesin go fit score inside one year, Messi bin score two goals wey carry am pass Gerd Muller rekod wey don reach 40 years dem neva break am. Messi now get 86 gol for one year pass Muller own wey be 85.

Messi, wey be 25 years bin and na d World Player of d year bin equal the record when im score d fess goal for Seville. Im carry ball from midfield for d 26 minut come carry d Betis defence dance 'alanta' before e take shot wey enter small angle, for d right side of gol post enter net.

Andres Iniesta na im set up Messi for d second goal, as im klever bak hil set am up as e take shot jus like d fess one inside d penality area wey enter the same corner again.

" i no send any rekod, like i dey always yarn, d koko be say make the team win, to win na im sweet pass, as e go even make us gap our opponent dem well well" Messi bin talk for interview wey e get afta d match wit Spanish TV broadcaster Canal Plus.

" wetin dey my mind when d year start na to try win eferitin with our team, for lig, for King Cup , for champion lig sef, na wetin i dey always start wit be dat" Messi talk.

Messi wey be the favorite to win d World Playa Award wen dem announce d winner next month don hamma 74 gol for Barca come add anoda 12 for Argentina dem, wey carry am pass Mueller total for Bayern Munich and Germany dat time for 1972 Im don score 56 for La Liga, 13 for Champion Lig, 3 inside King Cup and 2 for Spanish Super Cup and im still get two Lig match and one King Cup match to take incris im gol before year finish.

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



Dr Errol Sweeney
Why are referees explaining their decisions?
Match officials make mistakes because they are like you and me - human. However, in modern...

John Dykes
A day for sentiment, stats and hard cash
The title may have been won weeks ago and the relegation issues settled seven days back but there...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...

Neil Tovey
Khune top of the class
Kaizer Chiefs are on the verge of clinching their first league title since 2005. One man’s name is...