Mikel don sign new 5 year contract
by Andrew Randa 06 December 2012, 09:10
John Mikel Obi don sign ogbonge new 5 year contract with Chelsea dem wey go carry d Naija defensif midufilda reach 2017 with d champion of Europe.
Mikel, wey join Chelsea from Lyn Olso wey dey Norway for 2006 talk on Wednesday say " i don win efritin with chelsea dem for the six year wen i dey here and e dey special to me well well"
Mikel wey be 25 years, don win one Engiland premier League title, four FA Cup, 1 League cup come carry Champion League add last season.
Im don dey get shirt to start match and na regula now since that time when Chelsea bin pursue Andre Villas-Boas wey bin dey bench am.
I don dey hit my peak as a player, but i wan dey improf efriday and room sef still dey for improvement"