Put kommot hat for Traore
by Ibitoye Shittu 08 February 2013, 07:17
De oga coachi for de Burkina Faso nationa team, Paul Put don troway salute to im strika Alain Traore with de role wey de guyman play wey helep Burkina Babes for dia push to reach de 2013 Afcon final.
Traore wey be 24year old don score 3goals for de group stage wich helep de Babes as na dem top group C with 5points and reach de kwatafinal since 1998.
Gbege kon happen wen Traore go carri injuri for dia lass group C game against Zambia on Januari 29 as de guyman no go fit tap ball for 3weeks.
“Traore na correct strika and we don dey miss am becos na hin goals helep us for dis our waka to de final as na important playa hin be,” De coachi tok.
Na Traore na im kill de joy of Naija pipu and fans for dia fess group C game 1-1 wey de Supa Eadus play against Burkina Faso as na him equalise for hin team wen Naija pipu don dey dance say dem don win.
Traore wey dey do hin futball business for FC Lorient for France kon later score 2goals for dia sekond game wey dem skatta Ethiopia 4-0.
Burkina Faso go play de Supa Eagus of Naija for de 2013 Nations cup final on Sunday.