Moses,Emenike dey go Dokita
by Ibitoye Shittu 07 February 2013, 10:08
Stephen Keshi wey be de Oga coachi for de Naija Supa Eagus don tok on de injuri mata of him two Naija supastars for dis 2013 Nations cup wey be Victor Moses and Emmanuel Emenike.
De two Naija playas carri knocks on Wednesday wen de Supa Eagus waya Mali 4-1 for dia 2013 Nations cup semifinal match wey dem play for Durban.
As de Naija team don collect dia ticket for de final on Sunday jeje for Johannesburg, Naija pipu and dia fans don dey fear weda de two important guru for Naija go fit play de final against Burkina Faso.
Keshin kon yarn us for supersport.com dat na Dokita go detamine weda dem go play de final or na for bench dem go sit down take watch am.
“I hope dia wahala no bad and I pray to Baba God make dem fit wen de Dokita assess dem becos na all of dem na hin I need for de team,” Keshi tok.
Emenike na him dey top de goal chart with Ghana strika Mubarak Wakeso as na 4goals two of dem don score, while Victor Moses wey be Chelsea playa for Ingland don score two for Naija for dis Nations cup in South Africa.