*All times CAT (GMT+2)

Football | Tori for Pidgin

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience

Caf don ask ojoro ref to kommot



Caf wey na dem dey control futball for Africa don vex ban Tunisian refiree wey be Slim Jdidi becos of de wayo and rigimo wey hin do for de semifinal game betwin Burkina Faso and Ghana on Wednesday.

Hicham El Amrani wey be Caf general seketry tok say Caf no dey happi at all with de magomago wey Jdidi take refiree de game.

“We don tell am say make im carry hin bag kommot for here as we don suspend am becos we no expect de kind level wey him take handle dat game,” Naso Amrani tok.

Among de katakata wey de refiree do Burkina Faso on Wednesday for Nelspruit na de red card wey him carry dash Jonathan Pitroipa and de guyman fit no play for de final against de Supa Eagus of Naija on Sunday.

Na dis Friday na im de organising committee dem go decide weda make dem allow Jonathan make im play de final against Naija Supa Eagus or make him sit down dey pray for bench.

Meanwhile, Burkina Faso don appeal, but El Amrani yarn say de onli thin wey go make Jonathan no miss 1game na if Jdidi wey be de refiree write for im report dat him make mistake for dat semifinal game.

“If de refiree fit write for de report wey hin go submit give us dat him make mistake, den de committee go consida and make dia decision but na de report be de final.”

Upon all de wayo wey de refiree do, Burkina Faso still win de game 3-2 against Ghana on PK.

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



Dr Errol Sweeney
Why are referees explaining their decisions?
Match officials make mistakes because they are like you and me - human. However, in modern...

John Dykes
A day for sentiment, stats and hard cash
The title may have been won weeks ago and the relegation issues settled seven days back but there...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...

Neil Tovey
Khune top of the class
Kaizer Chiefs are on the verge of clinching their first league title since 2005. One man’s name is...