*All times CAT (GMT+2)

Football | Tori for Pidgin

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Drogba © Gallo Images

Drogba don annoint Eagus



De skippo for de Ivory Coast nationa team (you fit call dem de Elephants too) Didier Drogba don troway salute to de Supa Eagus of Naija afta dem skatta de Elephants 2-1 on Sunday for de Afcon kwatafinal wey dem play for de Royal Bafokeng Stadium.

Drogba wey play for all de minutes against de Supa Eagus kon dey impress with de way de Eagus take chop dem as im tok say Naija go win de cup if dem carry on with de way dem take bulala dem kommot for South Africa.

“Walahi I dey impress with de way de Supa Eagus take play us and I want make dem carry de cup.

“I no sure weda any team go fit tackle Naija for de rest of dis competison becos na everyday dem dey improve and I wan make dem carri on with dia swagga and hard work as dem no dey gree to lose.

“Na Naija time be dis and I wan make we salute dem with de numba of home based playas wey dem carry come South Africa as Naija don tell us say correct futball dey de continent,” Naso Drogba tok.

Drogba wey don tap futball bifor for Chelsea for Ingland kon beg Ivory Coast pipu and fans make dem no vex as dem no fit pass de kwatafinal stage for de 2013 Afcon for South Africa.

“Na futball be dat, sometimes you go play well, but you no go win, and we try our best, but de thin no just work for us. I wan make our fans and pipu bear with us.”

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



John Dykes
Wunderbar Wembley date
I’m honoured to be part of SuperSport’s presentation team for this weekend’s Uefa Champions League...

Neil Tovey
Why Baxter’s way has worked
When Kaizer Chiefs first announced the appointment of Stuart Baxter, the decision was met with a...

Dr Errol Sweeney
Why are referees explaining their decisions?
Match officials make mistakes because they are like you and me - human. However, in modern...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...