I be ordinary soldja - Enyeama
by Ibitoye Shittu 04 February 2013, 05:54
De Naija Supa Eagus goalkipa, Vincent Enyeama don tok about im record as de guyman neva loss any kwatafinal game wey him don play for de Naija team.
Na Enyeama dey de post for Naija on Sunday as de Supa Eagus bulala de Elephants of Ivory Coast 2-1 in de kwatafinal for Rustenburg.
One amebo kon ask Enyeama about him kwatafinal record for Naija, but Enyeama tok say “I no even know how de thing happen as I no be special one.”
“Na only Baba God I go tank for dis achievements and nothin concern me with statistics.”
Enyeama wey dey keep him futball for Maccabi Tel Aviv don play more dan 70games for de Supa Eagus since 2002 wey him fess make him debut for Naija.
Naija pipu and fans go still dey expect am to carry on with im fine form wen de Supa Eagus go skatta ground with Mali for de semifinal on Wednesday.