Mali peel Bafana
by Ibitoye Shittu 03 February 2013, 08:31
South Africa wey na dem be de hosts of de 2013 Afcon don crash kommot for de competison as Mali don flog dem for de kwatafinal on Saturday.
Na for PK na im Mali take beat dem 3-1 afta de fess, sekond half and de extra time finish 1-1.
Siphiwe Tshabalala na de onli playa wey score hin PK for Bafana Bafana (na South Africa nickname be dat) as na dem fess score for de game in de fess half.
Tokelo Rantie na im fess score for Bafana Bafana, but dia lead kon kpafuka for de sekond half wen Seydou Keita equalise for Mali.
De way wey South Africa take start de game no dey easy at all for Mali, as de kind attack and pressure wey dem give Mali no be small, but na sorry kon be dia name wen de game end as na Mali laf lass.
Afta extra time, Mali win 3-1 on PK
PK sequence: Tshabalala scores, Diabate scores; Furman saved, Tamboura scores; Mahlangu saved, M Traore scores; Majoro troway hin own
Teams:
South Africa: Khune, Gaxa, Masilela, Khumalo, Sangweni, Furman, Mahlangu, Phala (Serero 89’), Letsholonyane, Parker (Tshabalala 105’), Rantie (Majoro 41’)
Mali: So Diakite, Diawara, Tamboura, A.Coulibaly, Wague, Keita, Sissoko (M Traore 55’), Sow, Sa Diakite (Diarra 24’), Maiga, Samassa (Diabate 88’)