*All times CAT (GMT+2)

Football | Tori for Pidgin

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Eagles fan © Shengolpix

Eagus chop Elephant suya



De Supa Eagus of Naija don waka to de semi final of de 2013 Afcon wey dey go on for South Africa afta dem bulala Ivory Coast 2-1 on Sunday.

De Elephants (na Ivory Coast nickname be dat) start de game as dem show correct swagga, but Naija goalie, Vincent Enyeama dey kampe as im pari de shot wey Drogba play kommot.

E no tay at all wen De Supa Eagus also see de best chance to score for de 26th minute as Naija strika Emmanuel Eminike troway de oppurtunity.

Ivory Coast na dem be de favourite for dis competison, and Naija pipu and fans don dey fear bifor dem play dis game dat de Elephants go skatta de Supa Eagus.

But na lie as na de Eagus score fess for de 41st minute wen Naija strika Emmanuel Eminike score a fantastic freekick to put Naija for de lead as de fess half finish 1-0.

Emmanuel Emenike don score 3goals now for Naija and na him and Alain Traore of Burkina Faso dey lead de goal chart now but de guyman no go play again as hin don get injury.

Ivory Coast vex come out for de sekond half and dem equalize for de 50th minute wen Drogba play a correct freekick wen Naija defendas don sleep as dem allow Cheik Tiote score with him head.

Naija goalie, Vincent Enyeama save de Supa Eagus again in de 66th minute as him pari de shot wey Yaya Toure play for corner.

De two team kon dey play correct game for midfield, but na de Naija Supa Eagus laf lass wen Warri Wolves midfida, Sunday Mba score de wina for Naija in de 78th minute.

De Elephants try make dem equalize wen de final minute don dey reach, but de Naija Supa Eagus no gree as dem no allow dem to score.

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



John Dykes
A day for sentiment, stats and hard cash
The title may have been won weeks ago and the relegation issues settled seven days back but there...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...

Neil Tovey
Khune top of the class
Kaizer Chiefs are on the verge of clinching their first league title since 2005. One man’s name is...

Clyde Tlou
Enough is enough with racists
We love it so much and even call it the beautiful game but the beauty of this game we love so much...