Ghana Joker don loss
by Temisan Okomi 28 January 2013, 12:33
Ghana no go carri three of dia joker wen dem follow Niger play for de las match for Group B on Monday.
Ogbonge midfilda Mubarak Wakaso, defence general Anthony Annan and strika Richmond Boakye-Yiadom no go dey for de match wey go hapin inside Port Elizabeth.
De three of dem no follow dia mate train for inside Nelson Mandela Metropolitan University on Sunday nite.
Wakaso wey dey tap hin club ball for Spain, no go play sake of say hin bin colet hin second yellow card for de match wey dem follow Mali play.
Even if he no bin colet card sef, he for still no play, becos he be like say he wound hin knee for de match sef.
Ghana coachi, Kwesi Appiah, don tok say he go redi for kwatafinal sha, if Ghana reach las eight.
,p>De Black Stars (Ghana guyname) no go still fit use Richmond Boakye-Yiadom sef. De bobo (he dey tap hin club ball for Italo) bin wound hin blokos wen dem bin dey train for Abu Dhabi.
Annan sef, go still dey bench becos he wound hin leg wen Ghana follow DR Congo play dia fess match for inisde Group B.
Ghana musto waya Niger if dem wan be Group B oga.