*All times CAT (GMT+2)

Football | Tori for Pidgin

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Adebayor © Action Images

Togo turn Algeria to 'nes time'



Algeria na de fess contri to waka comot from dis year Nations Cup, afta Togo waya dem 2-kondo for inside Royal Bafokeng Stadium on Saturday.

Emmanuel Adebayor score for fess haf, den Dove Wome score hin own wen match don dey finish, to helep de Sparrow Hawks (na Togo guyname be dat) carri de three point for match wey bin hard dem small.

Algeria (na Fennec Foxes be dia own guyname) bin enta match wit beta gree-die and dem for score wen match jus reach 14 minit sef. Sofiane Feghouli bin nasa beta pass give Islam Slimani for de rite, but de guyman waya shot wey jus pass de goal post.

Na so Togo carri ball reach Algeria side afta dat one, and Mustapha Salifou troway beta cross give Adebayor near post. Adebayor jump pass Algeria defenda, Essaid Belkalem, but hin header pass side of net.

Wen match reach 22 minit, Algeria get corner and Feghouli cross am. Adlene Guedioura jump, head de ball, but Togo goalie, Kossi Agassa be like pussy, as he catch am bifor de ball near ground sef.

Togo goalie, Agassa, no rest, becos na so he dive reach hin lef side, as he push shot wey Algeria skippo, Mehdi Lacen, bin waya.

Upon de way Algeria dey press dem, na Togo come score. Time jus reach 31 minit for match wen Moustapha Salifou nod ball reach Adebayor front. He no miss. As Algeria goalie, Rais M'Bolhi, dey rush out, na so Adebayor jus tap de ball pass am come score.

E no reach five minit afta Togo score, and Algeria suppose score dia own too. Slimani colet one beta long pass for rite side, faya shot bit Togo goalie, Agassa rush out come block am.

As second haf reach, na so Algeria dey still try to score Togo and for 52 minit, Hilel Soudani reach one coret cross wey Foued Kadir nasa, but hin header pass side of post.

As match reach 70 minit for match, Slimani get beta chance. He run pass hin defenda, colet beta nasa from Djamel Mesbah, but de header wey he nod no good at all, as e go high.

Algeria still dey press Togo and dem for ekwalise wen time reach 84 minit, but Rafik Halliche block Hilel Soudani shot and Yassine Bezzaz see as de ball bounce reach am, but he waya shot over de bar.

Refree come stop match, sake of say de goal post bin bend one kin and dem go bring anoda one come put. As match start again, na so Togo sef get demsef. Wome run colet one kin pass and na so he place de ball inside Algeria net.Algeria 0 Togo (1) 2 (Adebayor 31’, Wome 90 + 1’)

Algeria: M'Bolhi; Mesbah, Belkalem, Halliche, Mostefa; Lacen (Bouazza enta for am for 83minit), Guedioura; Soudani, Kadir (Bezzaz enta for am for 66minit), Feghouli; Slimani (Aoudia enta for am for 75minit)

Togo: Agassa; Djene, Nibombe, Akakpo, Mamah Abdoul-Gafar; Amewou, Romao; Gakpe (Mani enta for am for 74minit), Salifou (Wome enta for am for 57minit), J. Ayite (Bossou enta for am for 90+1minit); Adebayor,

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



Dr Errol Sweeney
Why are referees explaining their decisions?
Match officials make mistakes because they are like you and me - human. However, in modern...

John Dykes
A day for sentiment, stats and hard cash
The title may have been won weeks ago and the relegation issues settled seven days back but there...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...

Neil Tovey
Khune top of the class
Kaizer Chiefs are on the verge of clinching their first league title since 2005. One man’s name is...