Burkina Faso bulala Ethiopia
by Ibitoye Shittu 26 January 2013, 04:46
Burkina Faso don vex for dis ogbonge 2013 Afcon wey dey go on for South Africa as dem take Bulala flog Ethiopia 4-0 for dia sekond game for group C.
De 4-0 kondo wey Burkina Faso don nack Ethiopia na im de de biggest win since de competison don start for South Africa on Saturday.
Na 1-1 draw na him Burkina Faso take start dia campaign against de Supa Eagus of Naija befor dem skatta Ethiopia on Friday.
Alain Traore score two goals for each half and Djakaridja Kone with Jonathan pitropa also score one each for Burkina Faso.
Burkina Faso don dey lead group C now with 4points afta dem play two games and dia ticket for de kwatafinal don dey ground as dem must avoid defeat against Zambia for dia last game next week Tuesday.