*All times CAT (GMT+2)

Football | Tori for Pidgin

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience

Moses don reach Canaan



Chelsea winga, Victor Moses, don finali redi to tap hin fess Nations Cup ball for Naija, as de Supa Eagus dey fin dia fess three point for inside South Africa.

Moses (de bobo na still pikin sha. He jus reach 22yrs) bin no dey fild wen Naija follow Burkina Faso play 1-1 draw on Monday, but e be like say he don redi to show hin skilla, wen Naija go play Zambia for inside Mbombela Stadium inside Nelspruit on Friday.

E be like say Moses wound don go, so dia coachi, Stephen Keshi, main gbege now, go be how hin wan choose de playa wey go play for front, for Friday 'win or waka' match.

”Victor train well, well yesterday (na Wednesday be dat) and we dey pray say he go redi to play wen match start. We dey look say if hin play, he go carri plenti gree-die enta fild,” na im Keshi bin tok.

Meanwilly, Moses by hinsef, bin don tok say he don redi to tap hin fess ball for Nations Cup.,/p>

Moses (hin bin don tap club ball for Crystal Palace bifor) no jus dey tink am say he wan play hin fess Nations Cup sef, he dey tink as dem go waya Zambia, and even win de cup for hin new pikin, Brentley Moses.

”I don dey follow hin mama tok sef and for my mind o, dis three point wey we wan colet for Zambia hand so, na for my pikin, and even to win de cup for dis South Africa sef,” na im Moses halla.

Victor Moses don tap ball for Naija seven tines alredi, since de fess match wey he play for Supa Eagus.

Hin fess match for Naija na for February 29, for inside Kigali, wen Supa Eagus bin follow Rwanda play match wey follow carri dem come dis Nations Cup.

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Live Video Streaming

Fri, 24 May @ 09:00
Fri, 24 May @ 11:00
Fri, 24 May @ 11:30
Fri, 24 May @ 12:30

Sports Talk



Neil Tovey
Why Baxter’s way has worked
When Kaizer Chiefs first announced the appointment of Stuart Baxter, the decision was met with a...

Dr Errol Sweeney
Why are referees explaining their decisions?
Match officials make mistakes because they are like you and me - human. However, in modern...

John Dykes
A day for sentiment, stats and hard cash
The title may have been won weeks ago and the relegation issues settled seven days back but there...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...