*All times CAT (GMT+2)

Football | Tori for Pidgin

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Zambia © Action Images

Zambia Presido tanda for dia back



Zambia Presido, Michael Sata, don yarn de Chipolopolo (na Zambia guyname be dat) say make dem waya evribodi wey dem go follow play, wen dem start dia Nations Cup gbege on Monday.

”Make una rememba say all Zambia pipu dey una back gidigba! Wen una start on Monday, make una fite well, well. No let mind fail una, make una fite like de pipu wey fite for Zambia. Una don win de cup bifor, but we wan make una win am again. Make una no tink anytin. Make una go play, and even if na de South Africa una meet sef, make una bulala dem well,” na im Presido Sata tok, as all man dey hail am.

No be onli Zambia Presido bin dey dia sef. Hin wife, Zambia Fess Lady, Dr Christine Kaseba bin follow am, plus dia Sports Minista, Chishimba Kambwili and oda obonge Zambia oga dem.

Na inside Protea Hotel for Nelspruit na im Zambia futbal oga, Kalusha Bwalya, bin helep welcome dia presido. Even oda oga from Zambia futbal bin dey dia, plus de Premier (na like govnor be dat) of Mpumalanga Province even send hin pipu to follow welcome de presido.

Zambia futbal oga, Kalusha Bwalya, come tank dia Presido well, well, sake of say hin dey suppot Zambia futbal and he no dey eva shake wen Zambia futbal want sontin.

”Oga, we belle sweet as you come so. Na de whole team na im happi so, and we go play beta ball for dis Nations Cup,” na im Kalusha tok.

Zambia, wey be current oga for Africa futbal, go start dia match for inside Group C on Monday, wen dem go follow Ethiopia play.

Na for Mbombela around five o clok na im de match go start.

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



John Dykes
Wunderbar Wembley date
I’m honoured to be part of SuperSport’s presentation team for this weekend’s Uefa Champions League...

Neil Tovey
Why Baxter’s way has worked
When Kaizer Chiefs first announced the appointment of Stuart Baxter, the decision was met with a...

Dr Errol Sweeney
Why are referees explaining their decisions?
Match officials make mistakes because they are like you and me - human. However, in modern...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...