Zambia go return Cup to Caf
by Ibitoye Shittu 16 January 2013, 11:41
(FAZ) wey na dem be the Futball Association of Zambia go officialy return the Afcon cup wey dem win last year to the confederation of African Futball (Caf) on Wednesday.
George Kasengele wey na him be the general secretary for the Zambia futball talk so.
Kasengele also yan us for supersport.com say the cup go later commot for the futball house on Wednesday before dem go carry am go give Caf (na dem be the controller of futball for Africa) for Johannesburg in South Africa.
“The thin go hard us, but we no get choice than to give dem back the trophy as we hope to carry ham go back to Zambia for anoda 2years,” Kasengele yan supersport.com.
Herve Renard wey na him be the oga coachi for the chipolopolo (na Zambia nickname be dat) tok say him and him boys go try make dem return the cup back to Zambia this year.
“We don dey South Africa and we dey here to carry the cup go home and we go do everything possible to succeed.
“2012 na amazing year for us, and I know we go do ham again,” Renard yan supersport.com.