Trabelsi dey voke for hin team
by Temisan Okomi 12 January 2013, 15:36
Tunisia coachi, Sami Trabelsi, don voke for hin team bifor Nations Cup start.
Tunisia don play many match as dem dey prepia for Nations Cup, and de las two dem bin play na Ethiopia and Gabon.
”My playa dem no tap ball well at all, and e jus be like say dem no sabi sef. We no fit enta South Africa go play dis kin ball for Nations Cup. De match for dia na helele and to tok true, we neva redi”, na im Trabelsi yarn supersport.com
”We still get one week and na de las bus stop to make sure say our team reach beta level. De playa dem musto show say dem wan wear our jersey.”,/p>
Even Tunisia goalie, Moez Ben Cherifia, gree wit hin coachie. He tok say, “we musto enta gear 4 bifor Nations Cup start.”
Meanwilly, Tunisia don take style ask Egypt weda dem go gree play 'play-play' futbal nes week, for UAE, bifor dem waka enta South Africa.
Tunisia (dia guyname na Carthage Eagus) go play for inside Group D, wit Algeria, Ivory Coast and Togo.
Dia fess match for Nations Cup na wit Algeria for inside Royal Bafokeng stadium on January 22.