Angola skatter African champion
by Ibitoye Shittu 06 January 2013, 07:47
Current Afcon Champions, Zambia don start the preparation of the title wey dem win last year January as Angola nack dem 2-0 in an international friendly match on Saturday.
Angola score for the first and second half in the match wey sweet for the Dobsonville stadium wey dey Johannesburg as the game go helep the two coaches to decide on their final 23 players wey go show for the Afcon.
Na 22 Players na him the Coach of Zambia, Herve Renard use for the game as na all him players wey dey camp him use for the 2-0 wey Angola hit dem.
Zambia go play dem first Afcon game on January 21 against Ethiopia before dem go face the Super Eagus of Naija and Burkina Faso.
Na for the big Mbombela Stadium na him all the countries wey dey group C go play dem group Afcon game. Dem be Zambia, Burkina Faso, Ethiopia and the Naija Super Eagus.