Money stop Angola Coach
Angolan press on Tuesday don report say na unpaid salary wahala na him stop Angola Coach, Gustavo Ferrin as him don refuse to travel with him boys for dem preparations for d Afrikan Nations cup.
Na four months salaries dem bin dey owe Ferrin and him on Monday meet with him Oga, d Anogolan futball fediration as him boys kommot go south of d country for dem to start trainin.
Na only 25 playas travel and dose wey dey play for obodo oyinbo no dey among and na 3 weeks dem go spend for Lubango for wich dem go play Cameroun, Gambia and Rwanda.
Ferrin who dis year July sign a two year deal vex kommot as him future as d Oga Coach no sure akkordin to wetin d newspaper write.
Angola dey group A and dem go play dere first game in Johannesburg for January 19 against Morocco. Dem go also play Cape verde Islands and South Africa for dere 2 oda games.