Drogba want 2013 AFcon cup
Didier Drogba wey don lose 2 Nations cup finas as captain for 2006 and 2012 don talk say d only tin wey him dey tink na to win d trophy next year for South Africa.
Drogba who bin won come back to Chelsea for him to build him fitnes bfor next year January wen d Chinese Ligue go don dey offseason, but FIFA on Thursday troway him loan request from shanghai shenhua.
“D tin b say, na regular futball go helep my game for d nations cup and na d reason y I bin won go Chelsea b dat.
“Na true say we don lose for two finas and dat one no mean say make we con slow our game as I want to make sure say I win d cup for South Africa,” Drogba talk.
Ivory Coast dey Rustenburg and dem go play Tunisia, Togo and Algeria for group D.