Cape Verde defenda no sure for AFcon
Cape Verde Islands intanationa, Ricardo say him no sure weda him go play for d next year's nations cup for South Africa as him no won kommot leave him club.
D playa say January and February wey b d time for d nations cup go dey tight for him club, Pacos Ferreira for Portugal as him don dey confuse weda to stay or make him kommot go play for him country.
D 32-year-old defenda also talk say him family and d numba of weeks wey him go take leave him club dey among d wahala wey de worry ham.
“Na great honour for me to play d nations cup and b part of history but I neva know weda I go go or not,”
Na for Portugal dem take born Ricardo and him bin play for Cape Verde for 2008 but now him no won leave him family or disturb d club wey dey pay ham salary.
Him club for Portugal, Pacos Ferriera dey fourth position for d ligue table.
Cape Verde Islands wey neva appear for nations cup for dem life go play South Africa in January 19 for Johannesburg and d d sekond day of dat game na hin Ricardo club go play a tough game with FC Porto.