Angola wan play three freindles for December
Angola nationa team bin dey plan to play friendlies games wey dem blieve say go jinger dem for d nations cup wey dey come for South Africa next year.
Futball fediration of Angola don dey negotiate to play Algeria, Zimbabwe and Namibia for December 16, 19 and 22 for Lubango.
Na d trainin camp wey dem go dey for South Africa na hin dem go play dese games.
D camp dey for players wey neva play for obodo oyinbo except Geraldo wey base for Brazil and na Monday d camp go open.
Angola dey also plan to play d super Eagles of Naija early January for portuga but na with all dem playas wey dey play Angola and Obodo oyinbo na hin dem won take face Naija.
But d two nations neva confirm weda dem go gree play d game or not.