Angola don release dem initial AFcon squad
Angola nationa team don call up 23 loca playas plus one strika wey dey play for Brazil to enta camp for Lubango as de dey prepare for d Nations cup.
Angola dey d same group with South Africa and d two of dem go play for dem sekond game for group A in Durban on January 23.
Veteran goalie, Lama don return to d nationa team with five oda playas who dey d team for d last nations cup for Equatorial Giunea and Gabon.
Na only one playa na hin Champions, Recreativo Libolo supply and na goalkipa Landu.
Geraldo who dey play for sekond division side, Parana for Brazil also dey among dose wey Coach ferrin call to camp.
D camp dey altitude so as to helep Angola adapt with d weda wey dey Johannessburg as na dere dem go play morocco for January 19.
SQUAD
Goalkipas: Lamas (Petro Atletico) Landu (Recreativo Libulo) Nebiu (Primeiro Agusto)
Defendas: Amaro Bastos (Primeiro Agusto) Dani Massunguna (Primero Agusto) Fabrieco (Interclube) Mateus (Petro Atletico) Lunguenha (Kabus Corp) Mingo Bille (Primeiro Agosto) Pirolito (interclube) Vado (Recreativo Caala)
Midfedas: Ary (Primeiro Agosto) Ito (Progresso Sambizanga) Kibeixa (Kabuscorp) Mabina (Petro Atletico) Manucho (Primeiro Agosto) Manuel (AS Aviacao) Miguel (Petro Atletico) Paty (Interclube)
Strikas: Geraldo (Parana, Brazil) Vado (Petro Atletico) Yano (Progresso Sambizanga)