*All times CAT (GMT+2)

Football | Tori for Pidgin

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience

Mourinho go teach Cape Verde Coachee



Cape Verde Island dem wey don qualify for deir fess eva Africa Nations Cup don turn to d 'Special One" make e ginger dem as dem dey prepare for d competition for South Africa.

Dem Island Archipelago don send dem coachee Lucio Antunes go Madrid ,make e dey take eye dey see as Mourinho dey run things, weda im sef fit gada sumtin from the ogbonge correct coachee, wey fit helep dem.

Cape Verde bin shock efribodi , come cause big big upset for Nation Cup histori dat time wey dem comot Cameroun for the qualifier, and na dem go take open mata for the competition wen dem play South Africa wey go be between Januari 19 reach Februari 10.

Efribodi bin see Antunes, wey be 46 years for telefision for Tuesday match wey Madrid bin play with Ajax for Champion League , dey wear Madrid dem jaket, dey siddon near Madrid bench dey look as Mourinho dey organise, dey run things.

Ego dey dat side dey do Mourinho five and six until Sunday, and e go even follow join for Madrid La Liga match wey dem get wit Real Valladolid.

D beta part of d tori say na Cape Verde dem Presido wey arrange all d parole, Jorge Carlos na im contact Mourinho imself come ask am make e helep dem, the countiri newspepa A Nacao bin report.

Na veri emotional experience for me and na de reward for all di hardwork, to beat Cameroun no be moi-moi d coach wey lif im work for Traffic control talk.

Dem go start d competition wen dem play South Africa for Soccer City wey dey Johannesburg for January 19 Cape Verde gofiment dey pay for pre-tournament trainin wey d team go go, na lass week sef dem announce say special special stamp go comot to celebrate dem qualification Antunes waka come be like dat one wey Sabri Lamouchi wey be foma France player do that time wen im be collect Ivory Coast coachee work.

Last month wey pass so, Sabri Lamouchi bin dey Madrid dey give Mourinho close marking, dey watch as Madrid dey train before dem play Borussia Dortmund for Madrid, the coachee sef happy come talk say na beta beta experience be dat " Mourinho dey follow efritin one by one, dey look am well well, im eye no dey miss anytin at al at al, and na dat kain thin e dey carry gif im players strength and confido" Lamouchi bin tell reporters dem.

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Live Video Streaming

Fri, 24 May @ 09:00
Fri, 24 May @ 11:00
Fri, 24 May @ 11:30
Fri, 24 May @ 12:30

Sports Talk



Neil Tovey
Why Baxter’s way has worked
When Kaizer Chiefs first announced the appointment of Stuart Baxter, the decision was met with a...

Dr Errol Sweeney
Why are referees explaining their decisions?
Match officials make mistakes because they are like you and me - human. However, in modern...

John Dykes
A day for sentiment, stats and hard cash
The title may have been won weeks ago and the relegation issues settled seven days back but there...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...