Jesus fit waka De Coachi for Benfica, Jorge Jesus don yarn say hin fit leave de club afta Chelsea don bilala Benfica 2-1 for de Europa League final on Wednesday Read full article |
|
Naja don rule Africa De Naija Supa Eagus don carri de 2013 Afcon title afta dem take style bulala Burkina Faso 1-0 for South Africa on Sunday Read full article |
|
Even with bronze Keita na baba Mali coachi, Patrice Carteron, don hail hin skippo, Seydou Keita, as dem carri third for dis year Nations Cup Read full article |
|
Today na today De Oga coachi for de Naija Supa Eagus, Stephen Keshi don yarn us for supersport.com dat nothin concern am with Burkina Faso strika wey be Jonathan Pitroipa as Caf don clear de guyman to play against Naija today Read full article |
|
Suppose dey wear green white green Many guymen dey tok say Naija suppose carri de cup on Sunday, wen dem go follow Burkina Faso dig am for Nations Cup final Read full article |
|
Afcon goals no gree come If you don dey carri eye dey look final for Nations Cup since, you sef go know say goal don scarce pass petrol sotay, na onli five goal we don see out of six final wey don hapin. Read full article |
|
Unity na Eagus secret Supa Eagus engine room for midfield, John Obi Mikel don yarn us for supersport.com dat na unity wey no dey de Eagus for de pass na hin kon be dia secret so far for dis 2013 Nations cup for South Africa. Read full article |
|
Afcon trophy dey hungry Enyeama De Naija Supa Eagus goalkipa, Vincent Enyeama don tok say na de best time for hin caria be dis to carri de Nations cup for South Africa Read full article |
|
Renard muss drop for Caf Caf wey be de pipu wey de kontrol futball for Africa don nack Zambia coachi, Herve Renard kondo as dem don tell am say make him pay $10 000, Read full article |
|
Trabelsi don waka Tunisia don gree make dia coachi, Sami Trabelsi, waka, as de team no bin waka pass fess round for dis year Nations Cup, na im dia futball pipu tok Read full article |
|
Pitriopa to face Eagus Burkina Faso skill factory, Jonathan Pitriopa, wey bin colet red card wen dem play Ghana for semifinal on Wednesday, go play Sunday final now Read full article |
|
Keshi shine torchlite ontop hin yarn Naija Supa Eagus coachi, Stephen Keshi, don dey yarn amebo dem, de tin wey make am tok say he fit waka leave Naija wen Nations Cup finish Read full article |
|
Dangote don spray Eagus millions De Naija Supa Eagus don dey swim in millions as a Naija business man, Aliko Dangote don dash dem N130 million as dia reward for de Nations cup final wey dem waka reach Read full article |
|
Put kommot hat for Traore De oga coachi for de Burkina Faso nationa team, Paul Put don troway salute to im strika Alain Traore with de role wey de guyman play wey helep Burkina Babes for dia push to reach de 2013 Afcon final Read full article |
|
Caf don ask ojoro ref to kommot Caf wey na dem dey control futball for Africa don vex ban Tunisian refiree wey be Slim Jdidi becos of de wayo and rigimo wey hin do for de semifinal game betwin Burkina Faso and Ghana on Wednesday Read full article |
|
Keshi dey rest hin joker Naija Supa Eagus don leave dia two strika, Emmanuel Emenike and Victor Moses, make dem rest, as dem dey train on Thursday Read full article |
|
Double wahala for Mali Na beta wailing bin full Bamako (Mali capital) on Wednesday, afta Naija bulala dem 4-1, as de whole contri bin dey pray say make dia team enta final Read full article |
|
Moses,Emenike dey go Dokita Stephen Keshi wey be de Oga coachi for de Naija Supa Eagus don tok on de injuri mata of him two Naija supastars for dis 2013 Nations cup wey be Victor Moses and Emmanuel Emenike Read full article |
|
Stallions tell Ghana bye bye De Stallions of Burkina Faso don reach de Nations cup final for de fess time in dia history afta dem flog Ghana kommot for de sekond semifinal on Wednesday as de Babes win 3-2 on PK Read full article |
|
Eagus take Mali drink garri De Naija Supa Eagus don become de fess team to carri dia bag waka to de final of de 2013 Afcon afta dem Bulala Mali 4-1 for Durban on Wednesday Read full article |